My val gone wrong!

'Ma, I'm around your estate, 
Ma I'm around your estate
You'll see me in 10 minutes'
Since morning vendor never reach my house from estate gate
Past 5pm number no dey go again
Na so e don enter voicemail 

Finally na myself I blame
No no no, na the truth
I blame myself 
My spirit bin tell me to do this Valentine codedly for hubby now see wetin Ogechi cause

Small neighbourly gist wey I tell Oge how i won really surprise hubby this time around
Na so she say she sabi somebody wey go organize the surprise even with complimentary paranra and love card as per Valentine with only chinkini money and they be "tested and trusted"

Na so I hurry pay oh
Oge never reach house since yesterday 
I don waka go estate gate 4 times, nothing
See how everybody status dey uhhhh and ahhhhhh
I just dey
My hard earned money!
Past 8pm I dey receive sms
'Dear customer due to the enormous orders today, we regret to inform you that we would not be able to deliver today but will do so before the end of the week'

Forghusake na so my customized boxers and singlet don go?
I must sue them, 500 million damages!



Comments

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

God, abeg break my bone and leave my phone!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!