Na born i born i no commit crime!
When i enter marriage, i arrange the perfect picture for head. Hubby, me and the children, how we go dey do things, wear uniform, chop for dining table, go outing... you know all those telemundo kind life.
Then i come born!
Husband wey i suffer marry, i no dey fit spend one minute with
Children wey i for dey run things with no even look my side twice before them overthrow my government. Everywhere 'Daddy, Daddy'.
Any small chance hubby dey house dem go monopolize the man oh, even small sharing is a no no.
So as i dey now i dey find 'Secrets to reclaim my lost kingdom' cos as i dey now i dey plan carry hubby go one month hide out. Besides no be me first meet the man?
I no dey share again. Make everybody go find their own man.
Comments
Post a Comment