Shalaye for Christmas!

Parara parara, everywhere, Mary don born ohhhhhhh
Wise men dey travel up and down to abi na from East?
Anyway, just know say East dey busy right now
Hotels all dey on lockdown, hooking up, flexing
New clothes, new people...

Baby girl can't be left out na, so the minute hubby say e go take me out for couple flexing, na so yours truly fly go bring out slay gown, fix nails, lashes...

To make everything balance, I dust my girdle abi na waist trainer dem dey call am now?
Come knack my stiletto!
Kai, Baby girl did sharp, looking stainless!
1hour into outing, I don dey see double double, I no come dey understand
I no fit laugh for hubby jokes again
Na only to pull wig remain

Small small I don start dey see Angels dey fly around my side
I even dey see white ladder sef? This kind, follow the ladder to heaven?
Omor na so I start dey bind and cast
Order wey hubby say make I do na so I dey look menu dey see 'To God be the glory'.

I no fit breathe again oh
As I say make I carry serviette use my last power take write my will, na so my spirit just whisper for my ear
'Chioma, respect yourself go komot that waist trainer before you die for nothing'
My people when I stand up from chair sef, I no remember because next thing I know be say I don pull waist trainer throw inside dustbin.
For Jesus birthday wey I won celebrate na him I go die put?
Na so I borrow myself sense oh
To get belle no be offence for constitution and e still no follow matter for heaven!

Comments

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

God, abeg break my bone and leave my phone!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!