Sibling life!

What is it na?
Na crime to get siblings?
I no like this kind thing oh
Person go get siblings e come be problem?
Na times like this I dey wish say na only me my Mama born.

Anybody follow me come from family wey dem many?
You buy Tshirts, dem go just give you the honourary privilege of being the first person to wear the clothes.
Next thing you know, you no go see clothe wey you buy again unless on top person body.
You use your small savings say make you buy one or two snacks just take hold body?
Den you do mistake carry am reach house?
My Dear, na everybody go follow you chop am oh.

One person go hide food, another go discover am and chop.
Person go cook, before e turn,spoons don appear, food don disappear.
But if Mama start dey shout for message, na so house go turn dessert, everybody go turn deaf and dumb or quietly disappear.

Today na as I dey, na red eyes I dey use write oh. Designee shirt wey I go buy make I use chokemy enemies na him I dey find so.
Who move my shirt? Nobody gree answer.
Make una help oh cos anybody wey I find wey hold my cloth, I go dis-brother am.

Comments

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

God, abeg break my bone and leave my phone!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!