What I ordered vs what I got!

Na now I come dey actually understand the pains of people wey no dey gree believe online shopping.
As you see me so, the mood wey I dey, if anybody mention online shopping near me, I no trust my reaction oh.
Oya make I carry gist give una.

So my friend Clara birthday dey come up.
Plans bin no dey oh but last minute alert enter, so babe come declare birthday bash this kind, two weeks to the day.
Na so ladies begin prepare na, nobody won fall hand.

I no even know wetin carry me go dey check clothes online oh.
Shebi I for jejely enter market as usual?
But that spirit wey won try mess up just carry me dey scroll
Gbagammmmmm,
I sight one mini silver dress like this!
I try dodge the temptation oh but by the time I dey wake for next morning na that dress I use speed go order.
Dey tell me delivery na 3 days.

My people, 3 days delivery, turn one week.
E finally reach my hand, dispatch rider say I must pay for delivery.
Something wey I include inside payment for the dress?
That one na another -#2500.
Finally, open the package, my people, e be like na baby mannequin them make the clothe for, not to mention the China white wey dem use everywhere like feather of mockery for the clothe.

After my friend Jenny laugh me finish, 
She come suggest sewing that dress with her fashion designer.
Ahhhhhhhh me? After wetin one antichrist tailor do me for Princess wedding? 
Na so I jeje enter market.
See ehhhhh, anything wey no be physical shop for sales, abeg I don wash my hand.

Comments

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

God, abeg break my bone and leave my phone!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!