Them go deny

Thank God say man no be God oh 
If not we for don chop sand
Thank God say e no dey man hand to determine wetin our star for be cos dem for don even move the whole star

Thank God wey dey always show up when matter critical
Thank God wey no dey leave us hopeless
As e carry our matter for head

Na so one madam go collect Angela for village
Promise papa and mama say e go train her
2years later them never even mention school talk more of to measure uniform for Angela
Na so somebody daughter dey hawk from street to market ontop hunger and torture

Third year na so motor jam Angela for the Hawking
Aunty go tell village people say Angela run follow man come leave letter for house
As God wey Sabi wipe person suffer comot, na so the people wey jam Angela na Ambassadors wey come Nigeria. Na so dem carry am, treat am and begin train am

15 years later, she land village for her papa compound
Na so papa and mama faint
Dem no recognize their pikin again

For all the people wey wish you bad
For all the katapot wey dem use envy fire you
God go turn up for your matter
And when you show up
Them go deny, them no know you again.

Comments

  1. Replies
    1. God no go shame us
      Men no go break us
      Na glory to glory go be our story.

      Delete

Post a Comment

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

God, abeg break my bone and leave my phone!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!