Null and void? Dorime!


Story story!
Na amebor carry me come here oh
You hear wetin I hear?
Say if you marry for Ikoyi Registry and other Federal marriage Registered too no be marry oh
Either be say you kidnap person daughter
Or her papa give you and you dey chop am since for free (no be me talk am oh, argue with your government)

The main Koko be say as them announce this matter this two days don hot oh
Some parents wey no like their pikin husband don dey collect their daughters back
Some couples don dey elope
Others wey dem dey beg to come do small thing for their pikin head wey since but coconut head no gree dem 
Errrrrrmmmmm now elders don increase price for list oh

🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣
Another set of people na the ones wey dey thank God for second chance
People wey snatch other people girlfriend or boyfriend, the real owners dey collect back
The ones wey family force to marry
Or the people wey dem partner don tire nkor?

On a serious side according to the Matrimonial Causes Act our country dey recognize three legit types of marriage
-Islamic marriage
-Customary/Traditional marriage or
-Court marriage(or a licensed place of worship)


So for dem people wey government say the court wey dem marry no legit, small hope still dey
If you know say you no carry person pikin run
You go village go collect list come do something for your woman head under custom then my brother no dey follow others shout anyhow because you dey very very married
The only thing be say na only court marriage dey support one man one woman marriage
So I hear say some men don dey run go do small thing for girls head before government change their mind unto say tradition permit am
My brother, no go do pass yourself so you no go run kiti-kiti or run kata-kata and you no go fit to drink water keep cup.

Word on the street: I hear say Angels don dey compile names of those wey dey live in fornication since (Book of life updating).

I come in peace!!!

Comments

Post a Comment

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

God, abeg break my bone and leave my phone!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!