Onwa Dezemba!

E don tey wey I know say this December wear koi-koi come
26th we dey so, yet we never see Santa for our area
Na him this evening youths for area come Waka round announce say we go contribute #300 each house to hire Father Christmas at least say them dey suspect as Santa be foreign guy bandits fit don kidnap am mid-flight to our location

Chineke!

Before the information go digest I see Mama Elizabeth wey we dey share fence with ghana-must go
No be like say I dey look oh
I dey cook for kitchen when I begin hear
'You must buy that fawo for Christmas if not hehehe, two fawo, crate of malt and fresh tomatoe.
See my friend Julie, na goat her husband buy'

Small time I say make I come pour small water outside cos I no dey hear the voice well we'll again
Na so I jam eyes with Mama Elizabeth with bag for head
Husband dey shout 'You won to kee me? You won to kee me?
Christmas clothes
Christmas hair
Christmas shoe, this and that'

I just say make I weed the grass wey dey disturb me for backyard before e give my children cough
Na so I hear 'Mummy D na so you worry your husband this Christmas?'

Heyyyyyyyyy, I smile in understanding come tell am say 'Sir God provides'

Abeg no tension anybody oh
If you no fit buy cow, buy goat
You no fit buy goat, buy fawo
If fawo too cost nkor? Fish still dey

Na our Lord and Saviour get the birthday no be you
In less than two weeks school fees and house rent go show
Package yourself make you no go dey ask for urgent 2k by 38th January.

Sipping my garri with chilled water and milk😋😋😋😋

Comments

Post a Comment

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

God, abeg break my bone and leave my phone!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!