Everybody go collect!

Una don hear the latest?
Delegate wey dem give dollars dey run go change am my people na so Delegate go discover say dollars na fake. 😂😂😂

See karma in action!

Your country people trust you, come choose you to go represent them and everything wey concern their matter.
You reach where them send you, like Judas wey you be, you sell them for coins.
Your people and your conscience you don sell, the money wey you come collect turn  out fake; double wahala.
See how swift judgment come for you?
Others wey don dey chop their own loot think say them don escape?

All of us follow dey shout for internet how things dey bad, how we dey suffer. Them come choose people inside us to help us. Na them go gum body use ghana must go collect their own share abandon matter for ground.
Sharp sharp Delegates don become hotter than jollof rice, dey buy car up and down, some automatically give themselves title.
Small opportunity to make a difference, dey don sell out. So wetin we all dey complain for na really because we want change for better or because we never fit see mainroad take collect our share?
If we no reform our minds use this opportunity change things for good, all of us go collect oh!

Comments

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

God, abeg break my bone and leave my phone!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!