Johnson do me Benjohnson
Johnson, Johnson!
How many times i call you?
Na only God go punish you for me.
After writing waec 4 times and e no favour me, i decide go small two years break. Na so i take start the sales girl work.
I dey shop with madam that faithful day wey i con decide to do small chat for 2go
We quarrel for chat room. From there na him we take connect, come be friends.
If to say i know say you be falling hand guy, shebi i for just face my front no answer you online.
Before you know, small small, we don strong pass top bond. Early mormor you don wake me, night time you go compose fine goodnight message for me.
Na so you take talk say you don fall in love, say na me you dey wait for all your life. As you dey pursue me like whirlwind, na so the love blow me yakata, so tey i even break up with Tolu my guy so that we go come be together.
Almost the fifth month na him we decide to see oh. I don tell all my friends and family pipo about you because you promise me heaven and earth.
Johnson, na so you carry address give me say make we see.
Na our last talk be that.
Okada wey i fly turn round town till we loss, come found again because everything wey you talk na lie.
Address na fake. Lie lie Johnson, your number no come dey go again.
Lie lie Johnson na so i say make i find you for Facebook, na so your picture with one baby girl full everywhere wey una just marry.
Johnson, lie lie Johnson, all the thing you promise me, lie.
Thank God say na only my closest friends i tell about you, cos the falling hand wey you give me, hmmmmmm.
So you get another baby girl somewhere but you dey busy dey make me fall in love. Na like so i take suffer heartbreak for no reason.
All my secret wey i tell you, the money i bin send send you, my madam wey almost sack me because of you, thank God say me sef no resign.
Johnson na so you do me benjohnson but e go be because what does not kill a man, them say e go make am stronger.
But finally Johnson, na only God go punish you for me.
Letter from a heartbroken Sisi.
lols
ReplyDeleteLove gone wrong
ReplyDelete