Hit the ground running!

We truly no dey hear word for this country
We no dey hear at alllllllll
For interview before Baba T become president, them ask am wetin make we expect if e win
And him answer honestly and truthfully
'Day 1: Hit the ground running
Day 2: Continue running
Day 3: Don't rest'
 
Day 1
Inauguration speech, Baba say subsidy don comot. Immediately, fuel price fly to #600.
E hit the ground running abi e no hit am?
Good!

Day 2
I wake up today to find fuel buy, na so filing stations close.
I drive back house empty.
We continue running

Day 3
E say 'Don't rest'
As I dey now I dey fear wetin today go be like.

Na so Buhari promise us change, and for speech e tell  us say I am for everybody and for nobody. Indirectly meaning say OYO.
We see am abi we no see am?
Now Baba T don promise us say e go hit ground running and the man dey deliver as promised for the passed two days.

The problem for this country na we citizens.
When these politicians come tell us wetin dem go do, we no dey believe them.
Like person inside abusive relationship, we think say them go change with time, instead the shege dey increase.
Anyways na here we dey for at least four years.
Na to buy shoe for the marathon oh!

Comments

Post a Comment

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

God, abeg break my bone and leave my phone!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!