Wahala no dey finish; try live life!

Wahala no dey finish
Bills no go stop
After you work hard like that horse for animal farm
Make you sef try dey chill

I ask hubby where e enter today
E say na table tennis e go slap
Way to decompress of work stress

My friend Aisha just call me 
'Chi, I just pay children school fees. Body dey pain me, my account no balance again. I dey go chop barbecue fish  with correct yoghurt'.

Omor, as e be for we country now, no let's things pressure you for any side oh.
Do as your power fit carry, then rest.
If na wetin you fit handle, step by step e go arrange. If you no fit, with time everything go clear.

Life is for the living, try make you live am.

Comments

Popular posts from this blog

Heavenly race?

FORK UP!!!

Un-mother me!!!