AFCON 2024
Abeg my people make una no vex oh. I still dey on this Super Eagles win of yesterday.
I went back today to watch the penalty again and I felt the tension afresh.
The only thing I can say is 'Thank God we won oh!'
Wetin man for do?
Yesterday that match no funny at all.
How people wey be football fans dey take manage survive to watch match?
Not to even mention say your club lose the match like ndi Arsenal
No kind of prayer wey I no pray
From warfare to praising in advance.
I hear say one former Honourable even die yesterday when them score Naija one of the penalty.
This kind sport is not for the weak oh
See how the whole country sef join dey praise the players. Some fans even go goalkeeper papa house go celebrate.
Na the same way dey go use drag players when dey lose.
The players sef, how they manage the tension take go score goal?
If na like this omor, this kind career path no be for me make I just dey support once once.
Looking forward to Nigeria winning this AFCON CUP OH!
Comments
Post a Comment