REHANDED!!!

I dey always hear story say dem dey thief people food for office since I no believe am.
I dey wonder how person go get mind go carry another person food and e no fear say dem go catch am or e fit get food poisoning.

So even for the abroad, some people dey monitor other people food oh.
Na today I confirm am.
For this office wey person dey work, wey I think say oyibo people dey mind their business.
Company even provide cereals oh and dem dey bring fruits and even some kinda snacks every alternate day.
Yet people eyes still dey chuk chuk.

Immediately I enter canteen today I no first notice say dem dey look my plate oh
As I microwave food finish come sit-down
Na then I begin hear
'Madam won't you eat your food?
Madam you don't want us to watch you eat?
You microwaved it and left it to press phone for so long it will get cold.
Madam you're always bringing different delicacies to torment us in this office. You have come again today's

My people na so I shock oh
No wonder since I enter this office my spirit dey always tell me to put my food for my locker.
Of course I invite dem come chop
But I thank God say I listen to my spirit oh if not na so I for dey find my lunch one day.
Shebi na the same spirit dey make students or teachers chop students food?
😂😂😂

Comments

  1. I remember when Teacher talk say make you increase the chicken you dey put for children food.

    ReplyDelete

Post a Comment

Popular posts from this blog

The Happie boys show!

PEOPLE LOVE BAD NEWS!

Bingo on the lose